Reaching Out From FUNAAB to The World

Tuesday 1 March 2016

Osheey Spending Dollars

"Good afternoon ma, I wan buy pure water"

"Good afternoon o ma pikin, how many u wan buy?"

"Give me twenty naira own"

"Ok I dey come"


————————
"Ahan, madam Wetin be this, how many u put for inside the nylon?"

"Na two my pikin"

"Ahan, no o, Wetin happen? Shebi na three for twenty naira una dey sell am before?Wetin come happen? I no collect again, Wetin?"

"Eyyys, come come come, why u come dey para on top my head? Shey na me increase ur dollar ni?"

"Where u see dollar for my hand, when we start to dey use dollar for Naija?"

"Woass, if u no wan buy again, yan me sharp sharp make I return my water before this heat, wey be like say dem pour petrol on top sun, fry my water"

"No Wahala madam, so na becus dollar increase, pure water wey be four for twenty naira turn two for twenty naira, sha give me. Abeg madam wait, how much be pure water wey no come cold?"

"Na two na"

"Gbese re o"

———————

Lol, dear readers, feel free to vent your own tale on spending dollars in Nigeria below. Let's humour ourselves 😂✌
Share:

1 comment:

  1. U wont believe that the hike in exchange rate has affected Glo Subscription!!

    ReplyDelete

Powered by Blogger.

Blog Archive